![]() |
| Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria perform clean & jerk during Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games |
Weightlifter Olarinoye Adenike Adijat has won Nigeria’s first gold medal at the ongoing Commonwealth Games in Birmingham.
Olarinoye recorded a total of 203kg in the event held at the weightlifting pavilion of the National Exhibition Centre, Birmingham, Saturday.
Weightlifter Adijat Adenike Olarinoye don win Nigeria first gold medal for di 2022 Commonwealth Games wey dey take place for Birmingham.
Olarinoye lift a total of 203kg to win gold for di women 55kg weightlifting event.
She bin lift 92kg for di snatch, 111kg for clean and jerk, and lift 203kg in total.
India lifter, Bindyarani Devi Sorokhaniban settle for di silver, while England lifter, Fraer Morrow settle for di bronze.
Olarinoye victory cause plenti jubilation for Team Nigeria camp afta di oda Nigerian lifters fail to make di podium.
Nigerians still dey hope say dia athletes wey go represent di kontri for di Commonwealth Games go win more medals afta Olarinoye victory.
Meet Adijat Adenike Olarinoye
![]() |
| Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria take part for di medal ceremony for Women Weightlifting 55kg Final on day two of di Birmingham 2022 Commonwealth Games |
Adijat Adenike Olarinoye na 22 years old according to her informate for di Birmingham 2022 website.
Dem born Olarinoye on 14 July 1999.
She come from Southwest region of Nigeria.
Olarinoye don first help Nigeria win three medals for 2019 African Games wey dem bin do for Morocco.
Dat time, She get di first gold medal of di day for di 55kg category.
She den later add anoda gold for di 55kg Clean-jerk category before adding anoda silver medal.
Olarinoye also win gold medal for di 2021 International Weightlifting Federation, World Championship wey take place for Tashkent, Uzbekistan.
What Barcelona Need To Register New Signings -Expert
Pep Guardiola show no concern over Haaland performance against Liverpool today.
Nunez's involvement proved crucial. Liverpool took a deserved 21st-minute lead through Trent Alexander-Arnold's s… •


