How Tobi Amusan break World record for Nigeria.
![]() |
| Nigeria Tobi Amusan bin break di world record for di semi-finals |
Tobi Amusan don become di first Nigerian to win gold for di Athletics World Championships.
Di Nigerian runner clock 12.06 seconds to win gold for di Women’s hurdles event for Oregon, USA
Amusan win her first ever worldwide title and medal for di 100metres hurdle of di semi-finals.
She run fast pass for di finals with 12.6 seconds time but dem no go register am as record.
Officiators say di wind bin dey too favourable (at +2.5 wen di maximum wey dey legal na +2.0).
Read Also:
News Today: Nigeria Wins First Gold Medal In Birmingham Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria perform clean & jerk during Women Weightlifting 55kg Final on day two of di B… •
Femi Adebayo Disregards Muslim Scholar Advise, Signs Endorsement Deal With Another Alcoholic BrandFemi Adebayo Disregards Muslim Scholar Advise, Signs Endorsement Deal With Another Alcoholic Brand photo credit from the e… •
Sunday bin mark ogbonge night for di Nigerian team.
Na for di last night of competition dem put demselves for di medal board.
And e for be two gold for Nigeria, as Ese Brume lead her long jump field with her 7.02m jump.
But German, Malaika Mihambo (wey get Tanzanian roots), flog am for her fourth attempt at 7.09m.
And she even jump past dat one for her last attempt, with 7.12m.
Tobi Amusan just dey cry tears of joy as dem dey play di Nigerian anthem for Hayward Field stadium, Eugene, Oregon.
Dis fit be di greatest and proudest night for Team Nigeria for dis championships.
Tobi Amusan profile
Oluwatobiloba Amusan na Nigerian Hurdler.
Dem born her on April 23, 1997 and she from Ijebu-Ode.
She dey school for University of Texas, afta she finish from Our Lady of Apostles Secondary school, Ijebu-Ode.
She finish 4th for di 2020 Tokyo Olympics and she just set new African record.
She be Nigeria National Champion and currently rank No 2 for di world.
She don win plenti Gold medals for Nigeria, especially for di Commonwealth Games.
African Games and di African Championships both for Relay.
Wit dis new African record, Amusan go be one of di top athletes from Africa wey pipo go wan see how she go perform for di Commonwealth Games for Birmingham, England from July 28 to August 8.
Tobi Amusan Stats for Athletics
Tobi Amusan currently be number 2 for di Women’s 100m Hurdles world ranking.
However for di Women's overall athletics ranking she be number 21, according to di International Association of Athletics Federation.
Di 25-year old don be World Champion, Diamond League final winner, and Commonwealth Games winner.
She don also end for di Top 8 of world championships.
Di Nigerian runner be two time All African Games winner as well as two times African champion.
She don gbab her first Commonwealth Games Bronze medal as well as win twice for Diamond League meeting.
She be NCAA Champion and en top 8 for di World U20 Championships, she be African Junior champion.
Amusan also dey for di Top 8 for di World (Continental) Cup.
IAAF report say Amusan bin contest for her first major competition at di age of 16 for di Donetsk IAAF World Youth Championships for Ukraine.
She bin run di 200 metre race, as well as, di Medley relay.
Howeva, her first move for athletics bin happun for Port Harcourt, Rivers State, Nigeria wia she bin contest for di AFN Golden League Meeting for April, 2012.
She bin compete for di Long Jump at place 5th with 916 score.
Ova her career, she don do Hurdles, 100, 200, 300 and 400 metre races as well as relay and long jump competitions.
Read Also:
News Today: Nigeria Wins First Gold Medal In Birmingham Adijat Adenike Olarinoye of Team Nigeria perform clean & jerk during Women Weightlifting 55kg Final on day two of di B… •
Femi Adebayo Disregards Muslim Scholar Advise, Signs Endorsement Deal With Another Alcoholic BrandFemi Adebayo Disregards Muslim Scholar Advise, Signs Endorsement Deal With Another Alcoholic Brand photo credit from the e… •

